Why you suppose dey bullish on crypto
06, May 2025

Why You Suppose Dey Bullish on Crypto
Since 2022 bear market, crypto don move from $1.5 trillion to $3.3 trillion.
Na almost $2 trillion gain just like that!
If anybody still dey doubt whether crypto get future, this kind growth don already give them answer.
Even during bear markets when things dey slow and price crash, the industry still dey hustle, dey build, and dey move forward.
Because make we talk true most people go rush enter crypto when market dey sweet, but once bear market show, dem go vanish.
For years, crypto believers don dey shout say blockchain go change the world, but e be like say na only small group of people really understand wetin dey happen. E no be their fault sha.
Maybe our early ginger bin dey too much, but one thing sure 2024 don lay solid foundation for a crypto future wey go far beyond just speculation!
Why We Believe This?
For the first time, governments and big institutions don start to embrace crypto.
Scalable, fast, and cheap blockchains don finally become reality something we don dey chase for years.
No be just hype again, we now get real-world applications wey dey solve practical problems and offer better solutions than traditional systems.
On top of that, global economy dey stabilize, and 2025 fit be the breakout year for tech innovations. Crypto dey among the top contenders to lead this next wave, no be just for one year, but for a long time.
Even if prices drop or economy shake again, crypto no go just collapse like before. This time around, perception don change, and we go explain why.
We go also show why, when we look back, 2024 go stand out as that year wey shift everything for crypto.
This na the moment we don dey wait for. E be like say that early hope and belief wey we get don finally get serious backing.
Now, crypto OGs don dey build with confidence, because real adoption don start.
Welcome to the new crypto era
BUT WAIT O
Before we fully enter celebrate this new trend, make we first give context about how e be to build in crypto before now.
Some of the challenges go shock you!
Wetin Eyes De See Before BUILDING IN CRYPTO BEFORE 2024
Crypto no be easy ride at all. E don face serious wahala some wey even make people give up. Make we break down three major problems wey the industry don battle:
1. Open-Source Coding
Crypto dey on top blockchain wey everybody fit see. That means your code go dey open to the world.
Now if you write code wey help people, and bad actors misuse am, na you dem go blame.
Like Roman Storm wey build Tornado Cash—dem arrest am even though he no plan to help criminals.
This kind situation make many developers run comot from crypto.
2. Banking Wahala
Imagine say you wake up and your bank account don freeze just because you dey into crypto.
This one real for many people, especially for Naija.
Banks dey fear crypto, and government no dey help matters, so accounts fit just freeze without warning. No be fair at all.
3. SEC and "Unregistered Securities" Wahala
SEC dey chase crypto projects say dem dey sell unregistered securities.
Big names like Binance and Coinbase fit fight the case, but smaller projects dey suffer.
Dem dey use money wey dem suppose use build, to defend themselves legally.
E dey kill motivation and trust for the industry.
Una See How E Be for Crypto?
The joy be say EVEN WITH ALL THESE PROBLEMS…
Crypto builders still dey push forward.
Many projects relocate go countries wey friendly to crypto.
But things don begin change.
BUILDING IN CRYPTO AFTER 2024: A NEW ERA
The dream? Make crypto founders no dey run from government again.
Countries go dey compete to attract crypto businesses with better policies.
This new era go make development safe, encouraged, and accepted.
Reasons We Believe Change Don Start:
1. The Trump Effect
Trump don dey use crypto as campaign strategy since 2024.
E show real support, not just campaign talk.
As e win election, e still dey push crypto forward.
Now, policies dey shift in crypto’s favor.
2. U.S. Government Too Slow and Inefficient
Trump wan reduce bureaucracy and regulations, make government fast and efficient.
New departments dey form, and dem dey look into blockchain use names like AVAX don enter discussion.
Elon Musk even involved!
3. U.S. Debt Wahala & Tech Leadership Battle
America dey lose tech leadership to China, especially in AI.
Trump realize say only innovation like crypto fit boost GDP and save U.S. status.
So he dey put pro-crypto technologists for important government positions.
So Wetin This Mean for Crypto?
The U.S. dey embrace innovation, and crypto go benefit heavily.
Other countries dey move, but U.S. still be global finance leader.
If America embrace crypto, e go change everything globally.
Wahala for who still dey doubt crypto!
Froala Editor