Ai predicts prices for 2025
06, May 2025

The top AIs don call the peak prices for 2025 for 3 major cryptos
Today, we ask five big AI models make dem give us 2025 price predictions for Bitcoin, Ethereum, and Solana.
The AI models wey we use na:
- OpenAI's ChatGPT o-1
- DeepSeek's R-1
- Anthropic's Claude 3.5 Sonnet
- X's Grok 2
- Meta's Llama 3.1
And the big question wey we go ask dem all be:
“Wetin una see for Bitcoin, Ethereum, and Solana price by 2025?”
Oya, make we start!
1. ChatGPT o-1
Source: ChatGPT
E be like say we dey start with the worst? ChatGPT dey bullish on $ETH, neutral on $BTC, but e dey bearish on $SOL reach the point where e 2025 peak price dey even $30 lower than Solana current price. Wahala.
2. DeepSeek R-1
Source: DeepSeek
E don better small for all assets this time, but Solana still dey collect woto-woto.
Now, make we assume person pack 100% of him portfolio inside $SOL – e suppose dey worry? (No be me ask o, na my guy.)
3. Claude 3.5 Sonnet
Source: Claude
Everything dey okay. We dey alright. I dey alright.
Claude training data stop for April 2024 – maybe na why e dey lowball crypto like say e no wan give us hope… right?
4. Grok 2
Source: Grok
Now we dey talk! This Grok guy fit sabi something… unless you be $ETH holder sha lol...
5. Meta’s Llama 3.1
Source: Llama
AI Average Predictions for 2025:
- Bitcoin ($BTC): $183,200
- Ethereum ($ETH): $9,860
- Solana ($SOL): $469
Moral Lesson:
Most AI models de bullish on Ethereum and Bitcoin. But dem de drag leg on solana one kind.
This means say dem de expect some other tokens to take over soon as Solana don too dey focused on memecoins instead of real projects way fit drive institutional adoption.
We get belief say one of the coins way fit overthrow Solana na AVAX and we go explain why in a different article.
That said, sha, the outlook for the rest of 2025 de bright and even if market de act up now we believe say things go soon start to de pump for these predictions to come through.
Wait o, where my Ledger? I need rebalance my portfolio before e go be like play. See you soon
Froala Editor