DEFINAIJA | Why Now Na The Worst Time To Give Up on Crypto
×

Earn And Invest In Web3

Jobs And Carrer In Defi Web3

Create News

About

Logout

Join Us










Earn And Invest In Web3

Jobs And Carrer In Defi Web3

Create News

About

Logout

Join Us






Why Now Na The Worst Time To Give Up on Crypto

26, Apr 2025

Why Now Na The Worst Time To Give Up on Crypto

(We dey here to guide you go success!)

You don watch sports film before? You sabi dat moment for middle of d last game wen everything just dey go bad?

Dem don try all season, but for halftime, dem dey locker room, heads down, scores no balance, e be like say dem go lose.

Then coach go enter, siddon for chair anyhow like say e wan yarn beta talk. Na dat kind moment crypto dey right now.

Last year Q4, we get mad bull run! Bitcoin dey hit new all-time high, government regulation dey soft, dem even dey talk about Bitcoin Strategic Reserve.

But suddenly, tariff wahala land, price drop 20-30% across many tokens, and now e be like say we dey down bad.

But no worry consider me your coach wey go give you dat halftime ginger!

See ehn, wetin we dey see now no be new thing. Na normal for crypto history.

Bitcoin get one thing dem dey call MVRV Z-Score (stupid name but e make sense). E dey show if BTC dey overvalued or undervalued.

If e dey zero or below, e mean say BTC market cap dey equal to or less than the real value na sign say we dey near market bottom.

If e don pass 7, e mean say BTC dey overvalued and e fit crash.

Right now? History dey show say we fit enter one last crazy bull run before e cool down.

But Wetin Economy Dey Talk?

Big companies dey buy more goods/services, e mean say economy fit grow soon.

US economy still dey strong (GDP dey go up).

US companies dey pass earnings target.

If you look am well, the market fit shake, but e no be end-time wahala. Na just that movie moment wey be like say all hope don lost but if you reason am well, you go sabi say the team go still win.

So now na d worst time to give up on crypto.

Froala Editor