Definaija- Home
×

Earn And Invest In Web3

Jobs And Carrer In Defi Web3

Create News

About

Logout

Join Us










Earn And Invest In Web3

Jobs And Carrer In Defi Web3

Create News

About

Logout

Join Us






Welcome,

Trending News

Altcoin season don cancel

Last Updated: 11, May 2025

ALTCOIN SEASON DON CANCEL?Back in the day, we bin get like only three TV channel e mean say everybody eye focus for the same shows.(If one correct new show land, almost everybody go dey follow am.)But now, e don get like 126 cable channels for US alone, plus thousands of shows wey dey different streaming platforms worldwide.So e mean say as content don full ground, everybody eye don scatter dem no fit focus for one place again.Na the same thing we dey see now for altcoin space.For January alone, dem estimate say like 3 million new tokens don land, and as we dey talk so, total tokens wey don exist don reach 39.5 million.And e go still increase.Make I put am like this: for 2020–2021, average number of coins/tokens wey dey exist na like 1.63 million, for 2017–2018 e be like 40k, and for 2013–2014, e no pass 500.E mean say right now, investors eye don scatter pass before everybody dey look different altcoins at the same time.E reach like this wey some people dey talk say altcoin season no go happen again this cycle (wey be the time wey like 75% of the Top 50 coins go perform pass Bitcoin for 90 days back-to-back).But we no gree dat one.We still believe say altcoin season go happen – but e get some conditions. Forget timing, focus on the data.People too like to dey argue about the timing for altcoin season – but the truth be say altcoin season no dey follow calendar date, na the ISM we go dey watch.(ISM na one survey wey dem dey ask US companies: "Una dey buy plenty goods now because una believe say better business dey come?")The more goods wey dem dey buy → the more dem believe say better days dey come → the more hope dey high → risky assets like altcoins dey shine for dat kind time.To cut long story short: once ISM pass 50, e dey show say altcoin season dey near.And guess wetin? E just pass 50 for the first time in almost one year…We fit still dip below 50 again (dem dey update this thing every month)  but for now, e be better sign!This altcoin season no go cover everywhere with the 39 million plus altcoins wey full ground the days of "just pick any altcoin and e go blow" don waka.E mean say if you wan cash out, forget guesswork, start dey look which altcoin get better plan and solid project.The second easiest way to find beta alts now na:Look for the ones wey dey do token buybacks and burns (we explain dat one here), e.g. Maker ($MKR), Raydium ($RAY), Jupiter ($JUP), etc.(If dem get money wey dem fit burn, e mean say dem dey do something correct.)…But before altseason go start, we need make this pullback clear first.Better news be say, we just talk with Real Vision Chief Crypto Analyst, Jamie Coutts, and e yarn us when market fit start dey move again!Froala Editor

Read More

0 LIKES. 0 COMMENTS


Intuition vs your $BTC stack

Last Updated: 06, May 2025

Institutions vs. your $BTC stack βš”οΈ$BTC: The first trillion $ asset wey individuals get pass companies 🫡Last night, I get one “Chai! Dis one just scatter my whole idea of Bitcoin!” moment as Telegram message land for my phone...And now, I wan make you feel the same way.But the tori first start for our Discord research channel…1. For 9:32 AM (ET) yesterday, Raul drop dis one for chatIf dis chart mean anything, last year, we see how $BTC dey move from individuals go institutional funds – e fit explain the kain market vibe we dey feel now.2. For 4:05 PM (ET) yesterday, Jay drop dis one for Telegram…E come add dis chart wey show say out of the 21M Bitcoin wey dem go ever create 14.6M, or ~69% (nice) of the total supply dey individuals hand.Part 1 of my “Chai! Dis one burst my head!” moment...True true, e be like say institutions don take over Bitcoin world but if we check am well, dem just dey start the race, and we wey be retail holders don lap dem plenty times.(Omo, we fit even don enter locker room dey bath self.)And wetin retail holders no sabi do? Hold Bitcoin for long.Which mean say if institutions wan collect $BTC from normal people hand, e go dey slow and scatter-scatter.(I.e. the more people wey dey hold, the harder e go be to buy plenty $BTC.)Part 2 of my “Chai!” moment...Take dis one:Come reason am well…Di demand burst expectation for 2024:For 2023, Matt Hougan (Bitwise’s CIO) talk say expectation of $10B-$30B in $BTC ETF inflows for 2024 na "joke" but the $BTC ETFs don already see net inflows of ~$36.2B for 2024.ETF first year dey always slow meaning say 2025 and the years wey go follow fit even pass wetin we see for 2024.Di supply wey remain no plenty again:Only 5% of $BTC supply remain, and dem go dey release am small small from now reach 2140 (I swear) so e go hard to fit balance institutional demand and still keep $BTC price stable.You dey feel am? Dat “Chai! Dis thing don clear for me” moment don dey come, abi?Froala Editor

Read More

1 LIKES. 0 COMMENTS


Why you suppose dey bullish on crypto

Last Updated: 06, May 2025

Why You Suppose Dey Bullish on CryptoSince 2022 bear market, crypto don move from $1.5 trillion to $3.3 trillion.Na almost $2 trillion gain just like that!If anybody still dey doubt whether crypto get future, this kind growth don already give them answer.Even during bear markets when things dey slow and price crash, the industry still dey hustle, dey build, and dey move forward.Because make we talk true most people go rush enter crypto when market dey sweet, but once bear market show, dem go vanish.For years, crypto believers don dey shout say blockchain go change the world, but e be like say na only small group of people really understand wetin dey happen. E no be their fault sha.Maybe our early ginger bin dey too much, but one thing sure 2024 don lay solid foundation for a crypto future wey go far beyond just speculation!Why We Believe This?For the first time, governments and big institutions don start to embrace crypto.Scalable, fast, and cheap blockchains don finally become reality something we don dey chase for years.No be just hype again, we now get real-world applications wey dey solve practical problems and offer better solutions than traditional systems.On top of that, global economy dey stabilize, and 2025 fit be the breakout year for tech innovations. Crypto dey among the top contenders to lead this next wave, no be just for one year, but for a long time.Even if prices drop or economy shake again, crypto no go just collapse like before. This time around, perception don change, and we go explain why.We go also show why, when we look back, 2024 go stand out as that year wey shift everything for crypto.This na the moment we don dey wait for. E be like say that early hope and belief wey we get don finally get serious backing.Now, crypto OGs don dey build with confidence, because real adoption don start.Welcome to the new crypto eraBUT WAIT OBefore we fully enter celebrate this new trend, make we first give context about how e be to build in crypto before now.Some of the challenges go shock you!Wetin Eyes De See Before BUILDING IN CRYPTO BEFORE 2024Crypto no be easy ride at all. E don face serious wahala some wey even make people give up. Make we break down three major problems wey the industry don battle:1. Open-Source CodingCrypto dey on top blockchain wey everybody fit see. That means your code go dey open to the world.Now if you write code wey help people, and bad actors misuse am, na you dem go blame.Like Roman Storm wey build Tornado Cash—dem arrest am even though he no plan to help criminals.This kind situation make many developers run comot from crypto.2. Banking WahalaImagine say you wake up and your bank account don freeze just because you dey into crypto.This one real for many people, especially for Naija.Banks dey fear crypto, and government no dey help matters, so accounts fit just freeze without warning. No be fair at all.3. SEC and "Unregistered Securities" WahalaSEC dey chase crypto projects say dem dey sell unregistered securities.Big names like Binance and Coinbase fit fight the case, but smaller projects dey suffer.Dem dey use money wey dem suppose use build, to defend themselves legally.E dey kill motivation and trust for the industry.Una See How E Be for Crypto?The joy be say EVEN WITH ALL THESE PROBLEMS…Crypto builders still dey push forward.Many projects relocate go countries wey friendly to crypto.But things don begin change.BUILDING IN CRYPTO AFTER 2024: A NEW ERAThe dream? Make crypto founders no dey run from government again.Countries go dey compete to attract crypto businesses with better policies.This new era go make development safe, encouraged, and accepted.Reasons We Believe Change Don Start:1. The Trump EffectTrump don dey use crypto as campaign strategy since 2024.E show real support, not just campaign talk.As e win election, e still dey push crypto forward.Now, policies dey shift in crypto’s favor.2. U.S. Government Too Slow and InefficientTrump wan reduce bureaucracy and regulations, make government fast and efficient.New departments dey form, and dem dey look into blockchain use names like AVAX don enter discussion.Elon Musk even involved!3. U.S. Debt Wahala & Tech Leadership BattleAmerica dey lose tech leadership to China, especially in AI.Trump realize say only innovation like crypto fit boost GDP and save U.S. status.So he dey put pro-crypto technologists for important government positions.So Wetin This Mean for Crypto?The U.S. dey embrace innovation, and crypto go benefit heavily.Other countries dey move, but U.S. still be global finance leader.If America embrace crypto, e go change everything globally.Wahala for who still dey doubt crypto!Froala Editor

Read More

1 LIKES. 0 COMMENTS


Ai predicts prices for 2025

Last Updated: 06, May 2025

The top AIs don call the peak prices for 2025 for 3 major cryptosToday, we ask five big AI models make dem give us 2025 price predictions for Bitcoin, Ethereum, and Solana.The AI models wey we use na:OpenAI's ChatGPT o-1DeepSeek's R-1Anthropic's Claude 3.5 SonnetX's Grok 2Meta's Llama 3.1And the big question wey we go ask dem all be:“Wetin una see for Bitcoin, Ethereum, and Solana price by 2025?”Oya, make we start!1. ChatGPT o-1Source: ChatGPTE be like say we dey start with the worst? ChatGPT dey bullish on $ETH, neutral on $BTC, but e dey bearish on $SOL reach the point where e 2025 peak price dey even $30 lower than Solana current price. Wahala.2. DeepSeek R-1Source: DeepSeekE don better small for all assets this time, but Solana still dey collect woto-woto.Now, make we assume person pack 100% of him portfolio inside $SOL – e suppose dey worry? (No be me ask o, na my guy.)3. Claude 3.5 SonnetSource: ClaudeEverything dey okay. We dey alright. I dey alright.Claude training data stop for April 2024 – maybe na why e dey lowball crypto like say e no wan give us hope… right?4. Grok 2Source: GrokNow we dey talk! This Grok guy fit sabi something… unless you be $ETH holder sha lol...5. Meta’s Llama 3.1Source: LlamaAI Average Predictions for 2025:Bitcoin ($BTC): $183,200Ethereum ($ETH): $9,860Solana ($SOL): $469Moral Lesson:Most AI models de bullish on Ethereum and Bitcoin. But dem de drag leg on solana one kind.This means say dem de expect some other tokens to take over soon as Solana don too dey focused on memecoins instead of real projects way fit drive institutional adoption.We get belief say one of the coins way fit overthrow Solana na AVAX and we go explain why in a different article.That said, sha, the outlook for the rest of 2025 de bright and even if market de act up now we believe say things go soon start to de pump for these predictions to come through.Wait o, where my Ledger? I need rebalance my portfolio before e go be like play. See you soonFroala Editor

Read More

0 LIKES. 0 COMMENTS


Crypto don win! Sec don drop coinbase

Last Updated: 06, May 2025

Crypto Don Win! SEC Don Drop Coinbase CaseSEC People Don Gree Cancel Di Coinbase Court Matter.No more wahala wey dem dey use power anyhow.No more fear say dem go just arrest person for nothing.Na full green light make we run our package without wahala or shaking.No be say I dey talk about when my mama pursue her useless boyfriend, Dave.(Even though e get small resemblance sha.)This one sweet pass! SEC people don gree cancel di case wey dem carry go court for Coinbase, dem just dey wait make di main SEC Commission sign off.In case you miss am: For June 2023, SEC talk say Coinbase dey help people trade 13 tokens wey dem call "unregistered securities" (like Solana, Near, and Polygon).Di thing funny because na dis same SEC for 2021 allow Coinbase enter stock market and some of dis same tokens dey di platform since dat time.For Coinbase e bad small, but e even worse for any other company wey wan do crypto business for Yankee. Di message clear:"No start anything. No try grow. If you try am, we go sue you."Wetin Dis New Update Mean?As dem drop di case, e mean say other crypto companies for Yankee fit start dey build without fear again.Before now, many companies and investors no wan touch crypto because dem dey fear SEC wahala now di fear don reduce.Coinbase sef fit run both offline and online project without fear again (dem don loose di chain wey hold dem).We fit even see plenty fresh money enter Coinbase side for di next few months (but dem go wait till di case cancellation don confirm finish).Na beta news full dis thing. Almost. Di only wahala small be say:Because di case no reach final judgment, no legal rule go dey to confirm say di tokens no be securities.(But e get as e be because court fit even rule say di tokens na securities if di case go far.)Anyhow, dis one na big morale boost for di US crypto industry, and di vibes fit even spread go global level (because crypto no get boundary!).In short: Di whole crypto space for US now get that "Dave no go show face again".E dey hot!Froala Editor

Read More

0 LIKES. 0 COMMENTS


Avalanche Latest News

Last Updated: 03, May 2025

Avalanche Latest NewsThe AVAX ecosystem saw a ton of growth and initiatives this past week. Here is a summary:A play-to-earn game, PlayCOQ, launched their alpha.Another AVAX play-to-airdrop game, FableBorne, launched their Season 2.Launch of AUSD stablecoin on Avalanche.Worldwide Avalanche Summit continues with the latest event in Buenos Aires, Argentina.PLAYCOQ AlphaOne of the many games on Avalanche where you can earn crypto (COQ tokens) has launched their alpha version.While the game is still under development, particularly for bug fixing, it is fully playable and is available for both Android and iOS users.And there might be rewards for early players.Interested? Download at linktr.ee/playcoqFableBorne Season 2 LaunchFableBorne is an RPG game on Avalanche and you can get rewarded for playing the game.More than 70,000 people are already playing so if you are interested in joining and competing for bigger airdrop rewards, download here:https://hub.xyz/fableborneAUSD launches on AvalancheStablecoins are one of the most profitable ventures in crypto, so more and more projects and chains are investing into stablecoins.The launch of AUSD is good for AVAX as it shows it's keeping up with the wider industry trends.Avalanche Community Event in ArgentinaThe worldwide Avalanche Summit continues with the latest event in Buenos Aires, Argentina.AVAX has been going around the world and organising meetups and parties quite recently. They were even in Nigeria.The latest stop is Buenos Aires, the Argentina capital.Froala Editor

Read More

1 LIKES. 0 COMMENTS


Argentina presido just do the biggest rug pull for history

Last Updated: 03, May 2025

ARGENTINA PRESIDO JUST DO THE BIGGEST RUG PULL FOR HISTORY?For Friday, the Presido of Argentina (Javier Milei) do this kain tins:E promote $LIBRA memecoin for one (wey e don delete) tweet…E talk say e go help Argentina economyDi tin blow reach $4.4B market capYou don already dey reason am say the mata never end for here.Na so e be, your brain dey correct.You think say $TRUMP and $MELANIA token launch bad? Dem dey learn work for where $LIBRA dey.(Jesu! Abeg take the wheel.)Wetin happen?Based on rough calculation:$LIBRA jump $4.5B market cap for the first 40 minutes of launch…But e lose like $900M per hour for 5 hours straight as insiders begin cash out.Make we check the matter well...Some big crypto people wey sabi the launch before e happen talk say dem don collect money to promote the coin from one firm wey dem call Kelsier Ventures.(Crypto Twitter dey para, dem wan see the list of the people, dem even call am ‘di Epstein list of crypto’.)The list never show, but we get chat wey happen between Kelsier Ventures founder, Hayden Davis, and Coffeezilla.For the chat, Hayden fit don confess to 7 different crimes wey dem dey suspect am for.Wetin go happen next?The kasala don dey burst already – as people dey talk:“Consequences no dey ever show face with lube.”Lesson wey we learn?Play mumu game, win mumu prize.Or if you wan hear am soft…Where you stand for dis matter?“🀝” if you dey follow fundamentalsOr“πŸ™ƒ” if you be proud degenmake we know for the comment section belowFroala Editor

Read More

1 LIKES. 0 COMMENTS


Tarrif Shockwave Don Hit Market

Last Updated: 03, May 2025

INVESTORS DON DEY RUN COMOT FROM RISK ASSETS (CRYPTO) LIKE MAD NOWFor the past 3 days, crypto market don jump up and fall back down like Kingda Ka rollercoaster.(RIP to the real one.)Make I break am down for you, wetin you miss, where we dey now, plus the small hope wey fit dey wey you never see...All the weekend gains don wipe comotTotal crypto market cap don drop like $350B from the weekend high, e don waka back to the price wey e dey before Crypto Strategic Reserve announce anything.Digital asset products see the biggest weekly outflows for record last weekFrom Feb 24 go reach Feb 28, like $2.9B waka comot from digital asset products – e dey show say TradFi people no wan do risk again.At the same time, 10-Year Treasury Yields dey fallPeople dey see Treasury bonds as ‘safe place’ (especially when market wahala dey) – and anytime people rush go buy treasury bonds, the yield go fall down.Gold sef dey shine…Make I summarize everything for you like dis…Investors don dey shift money comot from risk assets (crypto) enter safe assets like Gold and Treasury bonds because economic wahala dey grow.E bad abi?For paper, e no too sweet. But make I show you the silver lining wey dey inside the wahala:Most times, investors dey rush enter safe assets when dem believe say economy go weak – and weak economy dey always follow reduced inflation.(As economy dey weak → people go reduce how dem dey spend → meaning producers no fit dey increase price anyhow → inflation go slow down.)And na exactly this kind ‘weak economy with reduced inflation’ Federal Reserve wan see before dem go fit continue to cut interest rates.(If dem cut interest rates → loan and credit repayment go cheap → everybody go fit borrow and spend more → economy and asset price go rise.)So e mean say chance dey high say Federal Reserve go pump more fresh cash enter global economy – plus China and US Treasury fit join body too!…but e get one wahala.And if dem no solve am quick, e fit spoil our whole ‘silver lining’ plan.Froala Editor

Read More

0 LIKES. 0 COMMENTS


Why Now Na The Worst Time To Give Up on Crypto

Last Updated: 26, Apr 2025

Why Now Na The Worst Time To Give Up on Crypto(We dey here to guide you go success!)You don watch sports film before? You sabi dat moment for middle of d last game wen everything just dey go bad?Dem don try all season, but for halftime, dem dey locker room, heads down, scores no balance, e be like say dem go lose.Then coach go enter, siddon for chair anyhow like say e wan yarn beta talk. Na dat kind moment crypto dey right now.Last year Q4, we get mad bull run! Bitcoin dey hit new all-time high, government regulation dey soft, dem even dey talk about Bitcoin Strategic Reserve.But suddenly, tariff wahala land, price drop 20-30% across many tokens, and now e be like say we dey down bad.But no worry consider me your coach wey go give you dat halftime ginger!See ehn, wetin we dey see now no be new thing. Na normal for crypto history.Bitcoin get one thing dem dey call MVRV Z-Score (stupid name but e make sense). E dey show if BTC dey overvalued or undervalued.If e dey zero or below, e mean say BTC market cap dey equal to or less than the real value na sign say we dey near market bottom.If e don pass 7, e mean say BTC dey overvalued and e fit crash.Right now? History dey show say we fit enter one last crazy bull run before e cool down.But Wetin Economy Dey Talk?Big companies dey buy more goods/services, e mean say economy fit grow soon.US economy still dey strong (GDP dey go up).US companies dey pass earnings target.If you look am well, the market fit shake, but e no be end-time wahala. Na just that movie moment wey be like say all hope don lost but if you reason am well, you go sabi say the team go still win.So now na d worst time to give up on crypto.Froala Editor

Read More

1 LIKES. 1 COMMENTS


Todays market nuke explained

Last Updated: 26, Apr 2025

TODAY’S MARKET NUKE EXPLAINEDWetin Happen?If you wake up this morning dey ask:“I miss big news? Wetin cause this wahala? You think say I fit still rock wallet chain for my mid-thirties?”The answer na: no, we go break am down, and do your thing (but e no too sure).Everything wey we dey see for today market crash na case of “market don dey weak, fear dey rise, e cause plenty liquidation for different tokens.”E sound complex (and e dey) but we go break am down step by step make e clear like crystal.E make sense? Make we go!Mass liquidation dey happen when plenty leverage gather for certain price points.Na big grammar way wey mean say “plenty people don borrow money buy crypto, and dem go gas pay back if price drop reach certain level.”And how dem go pay back? By selling the remaining crypto wey dem get.Wey go make price drop even more… wey fit trigger more liquidation… and so e go dey go until price balance and people begin buy back.(Wey go make the market rise again.)So na like this e take happen in simple terms…πŸ‘‰ Market don dey weak for the past few days (crypto & stocks)…πŸ‘‰ Investors decide say make dem sell small…πŸ‘‰ Dis selling pressure push price down…πŸ‘‰ Liquidation levels come dey hit…πŸ‘‰ People wey borrow money to trade come dey forced to sell dia crypto to pay back dia loan…πŸ‘‰ The more liquidation levels wey dem hit, the more selling pressure go increase…πŸ‘‰ The more price go dey dip, until all the local liquidation points don clear…See one chart wey show how e take happen…The yellow lines be price points wey go cause $100M-$200M worth of selling make dem fit pay back loans (and na just Binance alone be dis).E no easy! But see as e be…All this na normal thing for crypto in fact, options market don dey hint say we fit see price drop reach $75k or lower since December (we don talk am two months ago).The koko be say: unless we dey close to the market cycle top (which, as Kyle explain for last week video, we still far from), this kind dip no be something wey suppose shake us.At worst, na “just bear am, e go pass” kind situation.At best, na “omo! Dis na big opportunity to buy more!”Remember: the moment wey you change your mindset from “red charts = sell!” to “red charts = buy!” investing go become easy like ABC!Froala Editor

Read More

1 LIKES. 0 COMMENTS


The US’ $7T Ticking Time Bomb

Last Updated: 18, Apr 2025

The US’ $7T Ticking Time Bomb THE US’ $7 TRILLION PROBLEM US get one big wahala…Dem gatz pay off $7 TRILLION debt for the next 6 months. The problem be say, US no get spare seven trillion to just drop (dem don already spend the money).So wetin dem go do? Dem go refinance (meaning: dem go carry new loan to pay the old one).But wahala dey… When dem carry the first $7T loan for COVID time, interest rate na zero but now rates don dey above 4%.E mean say US government gatz bring rates down sharp-sharp (if not, the debt repayment go turn wahala for future).The main issue? US economy too strong. Strong dollar and strong economy no go allow dem cut rates especially if inflation dey rise.So how dem fit drop rates fast? E get one old method dem go make everybody believe say the economy wan crash.(If people believe say US no go grow again, dem go pull money comot from economy, the dollar go weak, and rates go fall.)One way wey dem fit run this growth scare na to:Make Trump announce tariffs wey go slow tradeMake Elon Musk sack thousands of government workersGet one public gbas gbos with Zelensky (Ukraine president) to make people fear say global wahala go increaseIf na Trump plan be this, e be like say e don dey work small-small.See some charts wey dey show how strong US economy dey (remember: if economy weak, rates go drop).1/ The 10-year yield: e dey fallFor the past ~2 months, 10-year yield don fall from 4.79% to 4.22% (but e still get long way to go).2/ The $DXY (wey track US dollar value): e dey fallAnd e no just fall, e dey drop fast-fast – the $DXY see the sharpest 2-day fall since July 2023.3/ Truflation: e dey fallTruflation dey track inflation real-time (no be like CPI wey dey always lag behind). Less economic growth = producers no go fit jack price anyhow.Now – make we clear one thing:This whole ‘Trump dey crash economy so dem fit refinance cheaper’ na just theory. E never sure.Trump fit just be mumu wey no sabi economy, or e fit dey play 4D chess.Or e fit be say Trump brain no too dey there, but e get better economic gurus for e team wey dey play the 4D chess for am.Anyhow e be, US gatz make rates fall if dem wan refinance.The good news be say: most of the moves we talk (tariffs, Zelensky wahala, Musk sack spree) dey inside US government control.So the ‘short term pain for long term gain’ wey be say:US economy go cool small for short term →Government go refinance the debt →Later dem go cancel tariffs, settle with Zelensky, and tell Elon make e calm down, so the economy fit bounce back (while dem push the debt wahala enter future)Na real possibility be dat.Again, nothing sure yet but if you dey ask yourself “why this government dey always dey do anyhow?? E no dey ever get head.”This fit be one reason.Wetin go happen? Nobody sabi but we dey hope say e go work. Because if e work, e mean say:Things no bad reach as e dey look Markets fit just blow from hereFroala Editor

Read More

1 LIKES. 0 COMMENTS